Six BBNaija housemates from di ‘Shine Ya Eye’ Big Brother Naija reality TV show don dey up for possible eviction dis Sunday.
Di housemate wey dey qualify to nominate pipo bin nominate Arin, Emmanuel, Nini, Princess, Saga, Tega to leave di house.
But di new Head of House, Pere save Saga and replace am with Saskay.
Dis one mean say now Saskay go join pipo wey dey up for possible eviction on Sunday